Wikipedia
pcmwiki
https://pcm.wikipedia.org/wiki/Main_Pej
MediaWiki 1.48.0-wmf.1
first-letter
Media
Impotant
Tok abaut am
Yuza
Yuza tok abaut am
Wikipedia
Wikipedia tok abaut am
File
File tok abaut am
MediaWiki
MediaWiki tok abaut am
Templet
Templet tok abaut am
Hep
Hep tok abaut am
Katigori
Katigori tok abaut am
TimedText
TimedText talk
Modul
Modul tok abaut am
Event
Event talk
Phyno
0
3693
37772
37770
2026-10-31T20:30:19Z
Biowikician
24
37772
wikitext
text/x-wiki
'''Chibuzor Nelson Azubuike''' (dey bon am 9 October 1986) wey pipul sabi wel wel as '''Phyno''' na Naija rappa, singa, song-raita, an rekod produsa<ref>{{Cite news|title=Happy birthday cheers for Phyno from Olamide, Illbliss, Lil Kesh, others|url=https://thenet.ng/happy-birthday-cheers-for-phyno-from-olamide-illbliss-lil-kesh-others/|location=Lagos, Nigeria|access-date=9 October 2014|date=9 October 2014|archive-url=https://web.archive.org/web/20141012022951/http://thenet.ng/2014/10/happy-birthday-cheers-for-phyno-from-olamide-illbliss-lil-kesh-others/|archive-date=12 October 2014|url-status=live|newspaper=[[The Netng|The NET]]}}</ref><ref>{{cite web |last=Olajide |first=Medija |date=28 September 2024 |title=Phyno Greatest Achievement & Luxury 2024 |url=https://www.naijapickup.com/mp3-music/artistes/phyno/ |access-date=28 September 2024 |website=Np mesia}}</ref>. Phyno kom fom [[Anambra State|Anambra Stet]] bot na for [[Enugu state|Enugu Stet]] e tek gro op. E stat to dey du muzik as produsa for 2003 an na Igbo langwej e tek stat to dey rap.
E fest abom ''"No Guts No Glory"'' kom aut for March 2014. Insaid di abom muzik laik ''"Ghost Mode''", "''Man of the Year"'', "''Parcel"'', an "''O Set"'' de insaid<ref>{{Cite news|last=|date=30 June 2014|title=Music has no language – Phyno|url=http://www.vanguardngr.com/2014/06/music-language-musician/|location=Lagos, Nigeria|url-status=live|archive-url=https://web.archive.org/web/20140904140726/http://www.vanguardngr.com/2014/06/music-language-musician/|archive-date=4 September 2014|access-date=3 September 2014|newspaper=[[Vanguard (Nigeria)|Vanguard]]|language=en}}</ref>. Phyno oda abom wey e du na: "''Playmaker"'' (2016), "''Deal with it"'' (2019), ''"Something to Live for"'' (2021), an "''Full Time Job"'' (2024).
==Hau e tek stat laif an go skul==
Phyno kom fom Anambra Stet, an na for Enugu Stet e tek gro op. Di nik-nem ''Phyno'' kom fom di wod Fenomenal wey wan of im frend dorin im sekondri skul dez giv am. Na pilot dey ongri Phyno to du bot dem tel am sey mek e bi doktor. Phyno len to plei drum an piano wen e stil dey sekondri skul an e dey laik to sing di muzik wey e hie wey aktis don du. Phyno go ''Institute of Management and Technology'' wey de Enugu go rid Poblik Manejimet. Web wen e dey yia tu for di skul e stat to dey get moni fom muzik. For wan tok tok sho wit Ifeoma Onoye, Phyno tok sey e laik to bi laik [[Mr Raw]]. Na for 2010 e stat to dey rap an na dat yia e kom Legos to kontiniu e muzik karia. Na for 2012 Phyno stat to rekod im abom ''No Guts No Glory'' as muzikshan wey e kol to sing for di abom inklud Stormrex, [[Omawumi]], [[Olamide]], Efa, [[Flavour N'abania]], [[Mr Raw]], [[M.I]], [[Ice Prince]] an [[Runtown]]. Dem yuz Igbo langwej an Naijá pidgin tek rekod am. Phyno rilis ''"Ghost Mode'' wey Olamide folo sing insaid on 25 September 2012 as di lid singu of di abom. ''Ghost Mode'' win Best Kolabo at di 2012 "''The Headies"'' an Best Kolabo at di 2013 ''"Entertainment Awards''"
==Wie wi gada di tori==
{{Reflist}}
k7e0g5dbw27qnhoi3wqczazf5eauasv