Wikipedia pcmwiki https://pcm.wikipedia.org/wiki/Main_Pej MediaWiki 1.48.0-wmf.4 first-letter Media Impotant Tok abaut am Yuza Yuza tok abaut am Wikipedia Wikipedia tok abaut am File File tok abaut am MediaWiki MediaWiki tok abaut am Templet Templet tok abaut am Hep Hep tok abaut am Katigori Katigori tok abaut am TimedText TimedText talk Modul Modul tok abaut am Event Event talk Bello Turji 0 3200 37848 34149 2026-11-13T06:13:45Z Biowikician 24 37848 wikitext text/x-wiki '''Bello Turji Kachalla''' (dey [[bon]] am in 1994) wey bi sabi wel wel as '''Turji''' na [[Naija]] pesin wey bi di lida of grup-dem wey dey kili-kili for Naija. Dis pipul-dem dey du dia bad tins in di Norta-Westa aria of Naija laik [[Zamfara State|Zamfara Stet]], [[Sokoto State|Sokoto Stet]] an [[Niger State|Niger Stet]]. For 2022, Turji gang du plenti kili-kili of pipul for Zamfara. Dis kilin rish 200 pipul. Smol smol pikin-dem an wuman-dem folo [[death|kpai]] for dis opureshon wey Turji bad gang dey du. ==Hau im tek stat laif== Na for Shinkafi Lokal Govamet wey de Zamfara Stet, Naija dem bon Turji. Im na Fulani. Turji no go skul bot e sabi te-kia of cow (malu) wel wel. Turji tok sey one ''grup'' wey dia nem na ''Yan Sakai'' tif som of im cow as di grup stil kpai six of im brodas-dem. ''Yan Sakai'' na wan grup for Zamfara wey dey elp du siki-o-riti for di stet. Turji tok sey e papa wan kari di Emir of Zurmi go kot ( na di Emir dem giv di cow wey dem tif from Turji) bot di plan no wok. E stil tok sey di sem Emir of Zurmi kpai im onku. Wen Turji dey tok to Daily Trust Niuz-pepa, e tok sey na dis tins mek am kari gun an dey kpai pipul. Pipuk no Turji to bi di pesin wey dey kari aut di kili-kili of pipul an di polis an armi in di North-West rijion of Naija. For September 2021, di ''Yan Sakai'' vigilate grup enta wan ''mosque'' wey de ''Gwadabawa'' kilin eleven pipul. Dis one mek Turji vex kari im boiz enta Goronyo maket in Sokoto to kpai 50 to 60 pipul. Turji an im boiz for December 2021 stop one moto an put faya insaid di moto. Dis faya kpai ol di pasenja wey de insaid di moto an 30 pipul kpai insaid dis tins wey Turji an im boiz du. ==Big big pipul-dem wey e dey link to== Pipo dey tok sey Turji get koneshon with Dr. [[Bello Matawalle]]. Bello Matawalle bi di forma Zamfara Stet gofnor an im stil bi di kolrent minista of Stet for Difens in di [[Ahmed Tinubu]] administrashon. Pipuo tok sey Turji tok sey im an oda bad pipul-dem kolet 34 niu hilux moto fom di gofnor in 2019. m9by8a6hee942yf1ydo7pcx5khdyi01