Wikipedia
pcmwiki
https://pcm.wikipedia.org/wiki/Main_Pej
MediaWiki 1.47.0-wmf.12
first-letter
Media
Impotant
Tok abaut am
Yuza
Yuza tok abaut am
Wikipedia
Wikipedia tok abaut am
File
File tok abaut am
MediaWiki
MediaWiki tok abaut am
Templet
Templet tok abaut am
Hep
Hep tok abaut am
Katigori
Katigori tok abaut am
TimedText
TimedText talk
Modul
Modul tok abaut am
Event
Event talk
Eleanor Hague
0
2842
35470
35273
2026-07-26T00:22:19Z
InternetArchiveBot
52
Rescuing 1 sources and tagging 0 as dead.) #IABot (v2.0.9.5
35470
wikitext
text/x-wiki
'''Eleanor Hague''' (Dem [[bon]] am 7 October 1875 – E kpai 25 December 1954) na one wuman from America wey sabi di way dem tek sing old muzik for Latin America. Shi bi pesin wey dey stodi hau pipul from long taim tek sing and dans.
==Hau shi tek stat laif and go skul==
One taim for 1883, dem draw pisho wey show Eleanor and ha sista Mary as dem dey rilas for hammock. Na dia anti, Mary Hallock Foote, draw am.
Dem [[bon]] Eleanor Hague for San Francisco, California. Ha papa nem na James Duncan Hague, im na pesin wey dey wok for graund, dey find gold and oda mineral. Ha mama nem na Mary Ward Foote Hague.<ref name=":0">{{Cite web |last=Koegel |first=John |date=2013 |title=Hague, Eleanor |url=https://www.oxfordmusiconline.com/grovemusic/display/10.1093/gmo/9781561592630.001.0001/omo-9781561592630-e-1002283056 |access-date=2025-04-20 |website=Grove Music Online |doi=10.1093/gmo/9781561592630.article.a2283056}}</ref> Ha mama pipul — di Foote famili — bi famili to plenti big-big famili for New England said. One of ha anti, Kate Foote Coe, na pesin wey dey rait tori. Anoda uncle, Arthur De Wint Foote, na big enjinia and im mari pesin wey dey draw buk pisho, Mary Hallock Foote.<ref>{{Cite web |title=The Foote Family |url=https://thenorthstarhouse.org/foote/ |access-date=2025-04-20 |website=The North Star House |archive-date=2023-03-04 |archive-url=https://web.archive.org/web/20230304003027/https://thenorthstarhouse.org/foote/ |url-status=dead }}</ref> Anoda of ha anti mari one politishian wey im nem bi Joseph Roswell Hawley. Dia gel-pikin, Margaret Foote Hawley, wey bi Eleanor kozin, na atist tu.
Eleanor go len muzik for New York and Massachusetts, and shi stil travul go France and Italy go len more.
==Wok wey shi du==
Wen shi stil dey yong for New York, Eleanor join New York Oratorio Society — na grup wey dey sing beta muzik. Shi ivun bi pesin wey dey lid choch kwaya.
Eleanor Hague laik to kolet and kip old songs from Latin America and old-taim Spanish California. For 1925, ha nem show as pesin wey arenj one song wey dem kol “Carmela,” wey one wuman wey sabi sing, Dusolina Giannini, sing for Victor kompni.
One big tin wey pipul sabi ha for bi say shi faind one old buk wey one Mexican dans ticha from long taim — Joseph María García — rait. Di man rait hau dem dey du plenti dans steps insaid di buk.
Eleanor also help to chenj old Spanish songs into English, and shi wok wit pipul laik Luisa Espinel, Juan Bautista Rael, and Marion Leffingwell. Somtaims, shi go sing di songs and play piano or guitar join.
For 1932, shi tok for Los Angeles Public Library abaut old Spanish muzik. For 1930s, shi yuz ha own moni help pipul wey dey stodi Native American muzik. Shi help one komposa, Harry Partch, rait down old muzik wey Charles Fletcher Lummis rekod for old wax cylinder. Shi also sopot Frances Densmore wey dey stodi hau Native pipul tek du muzik and dans.
Eleanor stat one grup wey shi kol Jarabe Club for Pasadena, California. Di klob dey help children len old Mexican songs and dans. Shi dey tich dem and ivun direkt dem wen dem dey pafom. For 1941, shi kari di Jarabe Club dansas go pafom for National Folk Festival for Washington, D.C.<ref>{{Cite news |last=Jones |first=Isabel Morse |date=1942-04-12 |title=Sharps and Flats |pages=55 |work=The Los Angeles Times |url=https://www.newspapers.com/clip/120131928/sharps-and-flatsisabel-morse-jones/ |access-date=2025-04-20 |via=Newspapers.com}}</ref>
==Buks wey shi rait==
* "Mexican Folk-Songs" (1912)<ref>{{Cite journal |last=Hague |first=Eleanor |date=1912 |title=Mexican Folk-Songs |url=https://www.jstor.org/stable/534822 |journal=The Journal of American Folklore |volume=25 |issue=97 |pages=261–267 |doi=10.2307/534822 |jstor=534822 |issn=0021-8715}}</ref>
* "Brazilian Songs" (1912)<ref>{{Cite journal |last=Hague |first=Eleanor |date=1912 |title=Brazilian Songs |url=https://www.jstor.org/stable/534810 |journal=The Journal of American Folklore |volume=25 |issue=96 |pages=179–181 |doi=10.2307/534810 |jstor=534810 |issn=0021-8715}}</ref>
* ''Folk songs from Mexico and South America'' (1914, with Edward Kilenyi)<ref>{{Cite book |last=Hague |first=Eleanor |url=https://catalog.hathitrust.org/Record/100586960 |title=Folk songs from Mexico and South America |date=1914 |publisher=Gray pref. |location=New York}}</ref>
* "Spanish Songs from Southern California" (1914)<ref>{{Cite journal |last=Hague |first=Eleanor |date=1914 |title=Spanish Songs from Southern California |url=https://www.jstor.org/stable/534627 |journal=The Journal of American Folklore |volume=27 |issue=105 |pages=331–332 |doi=10.2307/534627 |jstor=534627 |issn=0021-8715}}</ref>
* "Eskimo Songs" (1915)<ref>{{Cite journal |last=Hague |first=Eleanor |date=1915 |title=Eskimo Songs |url=https://www.jstor.org/stable/534562 |journal=The Journal of American Folklore |volume=28 |issue=107 |pages=96–98 |doi=10.2307/534562 |jstor=534562 |issn=0021-8715}}</ref>
* "Five Mexican Dances" (1915)<ref>{{Cite journal |last=Hague |first=Eleanor |date=1915 |title=Five Mexican Dances |url=https://www.jstor.org/stable/534853 |journal=The Journal of American Folklore |volume=28 |issue=110 |pages=379–381 |doi=10.2307/534853 |jstor=534853 |issn=0021-8715}}</ref>
* "Five Danzas from Mexico" (1915)<ref>{{Cite journal |last=Hague |first=Eleanor |date=1915 |title=Five Danzas from Mexico |url=https://www.jstor.org/stable/534854 |journal=The Journal of American Folklore |volume=28 |issue=110 |pages=382–389 |doi=10.2307/534854 |jstor=534854 |issn=0021-8715}}</ref>
* ''Spanish-American Folk Songs'' (1917)<ref>{{Cite book |last=Hague |first=Eleanor |url=https://books.google.com/books?id=dx21AAAAIAAJ&pg=PA4 |title=Spanish-American Folk-songs ... |date=1917 |publisher=and New York, The American folklore society}}</ref>
* ''Early Spanish-Californian folk-songs'' (1922, with Gertrude Ross)<ref>{{Citation |title=Early Spanish-Californian folk-songs |date=1922 |url=https://catalog.hathitrust.org/Record/008948853 |access-date=2023-03-03 |place=New York |publisher=J. Fischer & Bro.}}</ref>
* ''Latin-American Music Past and Present'' (1934)<ref>{{Cite book |last=Hague |first=Eleanor |url=https://catalog.hathitrust.org/Record/001454829 |title=Latin American music, past and present |date=1934 |publisher=The Fine arts press |location=Santa Ana, Calif.}}</ref><ref>{{Cite journal |last=Corbató |first=Hermenegildo |date=1936-03-01 |title=Review: Latin-American Music Past and Present, by Eleanor Hague |url=https://online.ucpress.edu/phr/article/5/1/84/76740/Review-Latin-American-Music-Past-and-Present-by |journal=Pacific Historical Review |volume=5 |issue=1 |pages=84–86 |doi=10.2307/3633326 |jstor=3633326 |issn=0030-8684}}</ref>
* "Regional Music of Spain and Latin America" (1943)<ref>{{Cite journal |last=Hague |first=Eleanor |date=1943 |title=Regional Music of Spain and Latin America |url=https://www.jstor.org/stable/829339 |journal=Bulletin of the American Musicological Society |issue=7 |pages=26 |doi=10.2307/829339 |jstor=829339 |issn=1544-4708}}</ref>
==Ha pesona laif and wetin shi liv bihaind==
Eleanor Hague kpai for 1954 wen shi bi 79 yias old, for one ples wey dem dey kol Flintridge, for California.
Bifor she kpai, shi kari evri of ha impotant pepa and wok — inkludin dat Joseph María García old dans buk — giv one museum wey dem dey kol Southwest Museum mek dem kip am wel.<ref>{{Cite web |title=Eleanor Hague Collection, album |url=http://binder.theautry.org/archive/view/ms_203album |access-date=2023-03-03 |website=The Autry Museum of the American West |archive-date=2023-12-04 |archive-url=https://web.archive.org/web/20231204035002/http://binder.theautry.org/archive/view/ms_203album |url-status=dead }}</ref>
Yias leta, for 1996, one grup of smol pikin wey sabi play muzik for one town wey dem dey kol Atascadero, California, yuz di notes wey Joseph María García rait take pafom muzik for difrent shows. Dem kol di grup ''Children of the Hague Manuscript''.<ref>{{Cite news |last=James |first=Adam St |date=1996-06-07 |title=Young musicians bring lost treasure to life |pages=20 |work=The Tribune |url=https://www.newspapers.com/clip/120123375/young-musicians-bring-lost-treasure-to/ |access-date=2025-04-20 |via=Newspapers.com}}</ref>
==Wia dem gada di tori==
{{Reflist}}
[[Katigori:Pipul wey dem bon for 1875]]
[[Katigori:Pipul wey kpai for 1954]]
[[Katigori:Tori abaut pipul life]]
c8c71oe0x5gjijd7ysms8gy6dn125yl