Wikipedia
pcmwiki
https://pcm.wikipedia.org/wiki/Main_Pej
MediaWiki 1.47.0-wmf.13
first-letter
Media
Impotant
Tok abaut am
Yuza
Yuza tok abaut am
Wikipedia
Wikipedia tok abaut am
File
File tok abaut am
MediaWiki
MediaWiki tok abaut am
Templet
Templet tok abaut am
Hep
Hep tok abaut am
Katigori
Katigori tok abaut am
TimedText
TimedText talk
Modul
Modul tok abaut am
Event
Event talk
Festus Keyamo
0
2096
35559
26162
2026-07-31T06:29:57Z
KINDNESS 246
3724
35559
wikitext
text/x-wiki
{{Databox}}
'''Festus Egwarewa Keyamo''' [[SAN]], [[Chartered Institute of Arbitrators|FCIArb]] (dey [[bon]] am 21 January 1970) na [[Naija]] lorya, jornalist, an pesin wey dey fait for pipul wey dem du pashiha. Forma presidet [[Muhammadu Buhari]] chuz Keyamo as e daretor of Stratejik Komunikeshon wen e wan enta as presidet for sekod time.
==How e tek stat laif an go skul==
Na for 21 January 1970 dey bon Festus Egwarewa Keyamo in [[Ughelli]] wey de [[Delta State|Delta Stet]], Naija. Keyamo papa kom from [[Effurun]], one siti in Delta Stet.
Keyamo go ''Model Pamri Skul'' an du e sekondiri skul for ''Govamet Kolej, Ughelli''. E du e [[West African Senior School Certificate Examination|WASSCE]] for di skul in 1986. Keyamo leta enta [[Ambrose Alli University|Ambrose Alli Yunivasiti]] wey de Ekpoma in [[Edo State|Edo Stet]] to rid ''Law'' . Na for 1992 e kolet e B.sc satifiket in ''Law'' an e kwulify to go kot for December 1993.
==How e tek wok==
Na onda [[Gani Fawehinmi]] law ofis e tek stat to wok as lorya. E stat di wok in 1993 for Gani Fawehinmi ofis wey de [[Lagos State|Legos Stet]]. Afta Keyamo don wok for two yies for di ofis, e komot go fom e own Festus Keyamo ''Chambers''
Na Keyamo bi lorya of [[Asari Dokubo|Mujahid Dokubo-Asari]] for di kess wey e get with Fediral Govamet. Asari Dokubo bi di lida of ''Niger-Delta Pipul Volontiha Forss''. Na stil Keyamo bi di lorya wey difen [[Ralph Uwazuruike]]. Ralph Uwazuruike bi di lida of di grup wey dey fait for Biafra Riploblik MASSOB. Keyamo na one of di lorya wey chuk bodi for di kess of [[Bola Ige]] killin.
Keyamo in 2008 kari Fediral Govamet go kot bikos of di magomago way dem tek dey pik sarvis shif.
For 2017, na Keyamo Stephanie Otobo chuz to elp am kari pasto [[Johnson Suleiman]] go kot. Stephanie-Otobo wey bi singa tok sey di pasto slip with am finish no gree mari am again.
==How e tek wok for politis==
For 24 September 2019, Fediral Govamet chuz Keyamo as ''Minista of Stet, for Niger Delta''. Froma Naija presidet, Muhammadu Buhari leta chenj e wok to ''Minista of Lebor an Emplomet''.
==Awod wey e don kolet==
* For July 2017, e risiv [[SAN]] rank.
* ''Global Human Rights Award'' for September 2017 give am awod for e wok as e dey fight for human right for Naija.
p5vzp02djz6e873ch3phk0dydwaddxy