Wikipedia pcmwiki https://pcm.wikipedia.org/wiki/Main_Pej MediaWiki 1.47.0-wmf.19 first-letter Media Impotant Tok abaut am Yuza Yuza tok abaut am Wikipedia Wikipedia tok abaut am File File tok abaut am MediaWiki MediaWiki tok abaut am Templet Templet tok abaut am Hep Hep tok abaut am Katigori Katigori tok abaut am TimedText TimedText talk Modul Modul tok abaut am Event Event talk Oya 0 2833 36847 36845 2026-09-16T09:25:54Z Biowikician 24 36847 wikitext text/x-wiki [[File:Oya oriri in Oya grove 03.jpg|thumb|Oya statue in Oya Grove, Irra Oyun Local Government Area of Kwara State]] '''Ọya''' (for Yoruba, dem dey kol am Ọya, Oyá, or Oiá; Yàńsàn-án or Yansã; an for Latin Amerika, dem dey kol am Iansá, Iansã, or Iansan) na one kain Orisha wey dey kontro briz, tonda, an evii briz. As wota spirit, dem stil sabi Ọya as spirit wey fit bless pipul wey dey fain pikin, or pipul wey go im riva said for Niger Riva. ==Bilif abaut Ọya== Ọya don liv for dis wod as human bin. Shi kom fom one taun wey dem dey kol Ira, wey de [[Kwara State|Kwara Stet]] for [[Naija]] dis taim. Shi mari Alaafin of Oyo, Shango. For Yoruba, dem sey im nem "Ọya" kom fom “ọ ya,” wey min “shi tia,” bikos dem sabi am wit strong briz an wind. Ọya get pawa to chej imsef to buffalo, an for Yoruba tok tok, dem dey olwez tok abaut dis buffalo mata. Bikos of dis, buffalo na one of Ọya big sain, an e dey rong for im priests to [[death|kpai]] buffalo. Ọya dey olso kol '''Ọya Ìyáńsàn-án''', wey min “Mama of Nine,” bikos shi [[bon]] nine pikin wit im third hosband, Oko, afta shi don sofar to get pikin for long taim. Ọya dey guid Niger Riva wey Yoruba pipul sabi as '''Odò-Ọya'''. For Yoruba rilijion, Ọya mari three taim. Fest, shi mari Ogun (woriho Orisha), afta Shango, an leta, shi mari hunta an farma god, Oko. Ọya woship no dey evriwie for Yoruba land bifor. Na onli pipul wey di Oyo Empaya dey kontro dey woship am. Bot bikos of Atlantic sleiv tred, meni pipul wey dey woship Ọya fom Oyo tok sey dey kari am go Niu Wold (Amerika), and im woship kom de for plenti plez. Nau, Ọya woship don stil de for oda Yoruba aria. ==Ọya for Candomblé== For Candomblé (Afro-Brazilian religion), dem sabi Ọya as '''Oiá''', '''lyá Mésàn''', or most taimes pipu dey kol her Iansã (fom Yoruba wod Yánsán). Lik hau Yoruba pipu sabi Ọya, for Candomblé, ''Iansã'' dey kontro wind, thunderstorm, an lightning. Shi be queen of Niger River and na strong warrior wey nobodi fit win. Dem dey talk say ''Iansã'' get strong emotion, charm, and pawa. Shi stil get the pawa to kontro dead people matter and the mystery wey surround death. For Candomblé tradition, dem dey kompare '''Iansã''' to Saint Barbara, and for Angola Congo grup, red na her color. ==Ọya ritual food== One food wey dem dey uze for Ọya na '''Acaraje'''. Acarajé na round akara wey dem mek wit peeled an crushed black-eyed beans, and dem dey put small smol shrimp, okra, crush groundnut, an hot pepper for inside. Dem go fry am for red palm oil (dendê oil). Na traditional Afro-Brazilian fud and na Ọya offering for Candomblé tradition. Dem dey also do plain version of this akara for Ọya rituals, but the one wey get pepper and seasoning, dem dey sell am for street for Bahia, Brazil. Other foods wey dem dey use for Ọya na '''Ipete''' an '''Bobo''' de '''Inhame''' (yam porridge). For Yoruba saide, Ọya fud na '''Àkàrà'''. Eggplant, mulberries, pudding, an dark chocolate stil dey konnet to Ọya. ==Wie dem gada di tori== rs25jtv97fdrmstq8piep5k973470ei Yuza tok abaut am:Royalesignature 3 3582 36846 2026-09-16T09:02:26Z Biowikician 24 Created page with "==Rait wel for Naija Wikipedia== Tank yu for raitin in dis Wikipedia. Abeg, trai ondastad hau di komuniti don chuz to rait hie bifor yu stat to kreat atikul. Yu fit dey inkreas di klinin wok for dis sait. ~~~~" 36846 wikitext text/x-wiki ==Rait wel for Naija Wikipedia== Tank yu for raitin in dis Wikipedia. Abeg, trai ondastad hau di komuniti don chuz to rait hie bifor yu stat to kreat atikul. Yu fit dey inkreas di klinin wok for dis sait. [[Yuza:Biowikician|Biowikician]] ([[Yuza tok abaut am:Biowikician|tok]]) 10:01, 16 September 2026 (WAT) 8bd9rwgr57v4v7lmpw7lbgcvnf0yjv1